President Donald Trump don threaten say e go bomb Oman - US ally - if
dem "come dey disturb" im administration tok wit Iran, as Fox News report.
One reporter for di network tok say di US president tok dis wit bad
words during one phone call for Monday, wia e also tok say di US get
direct backchannel wit di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC).
The IRGC - na major military, economy and political force for Iran - dem later deny say dem dey follow US tok. But Iranian officials on Monday
tok say dem dey close to finalising di deal wit Oman on how dem fit ship through di Strait of Hormuz.
Meanwhile, di 60-day Memorandum of Understanding (MoU) go end for
Monday. Di memo na signed commitment from both US and Iran to continue
to dey tok until dem reach di final agreement.
Oman wey dey claim say dem dey neutral for dis conflict, don suffer some attacks from Iran since di gbege start. However, dem dey try negotiate
wit Iran to reopen di strait.
Since di US and Israel don attack Iran for February, Tehran don block di important waterway - wey about one-fifth of di world oil and liquefied natural gas dey pass. To reopen am don become major key point for discussion.
Washington don make dia own efforts to secure di reopening. Fox reporter Trey Yingst quote Trump say: "If Oman dey distract us, we go bomb di
shit out of dem."
One IRGC tok-tok pesin deny Trump claim, say US dey involved in
backchannel negotiation wit IRGC - wey be major military, political, and economic force for Iran.
One tok-tok pesin tell semi-official Iranian news agency Tasnim News:
"No discussion dey take place between IRGC officials and di Americans,
and dis lie by Trump na just fantasis caused by di delusions and
nightmares e don suffer becos of di defeat and desperation of di war."
Trump make di threat to Oman afta Iran tok on Monday say di two sides
don reach agreement for ships to fit travel through di strait.
Foreign ministry tok-tok pesin Esmaeil Baghaei tell tori pipo for Tehran
say "we don reach understanding about di map of di transit route."
Inside di statement, Baghaei tok say both sides go finalise di details
bifor dem go release joint statement. Oman don describe dis discussions
as positive.
Earlier dis month, Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi tok say full reopening go depend on edn Iran receive compensation from di US, as violations of di MoU.
Reuters - tok say one Iranian official - don report say Tehran dey seek
fees of between 5% and 7% of di price of cargoes from vessels wey dey
pass through am.
As Trump tok wen e dey phone wit Fox, e tok say im get direct
backchannel wit di IRGC, but im no dey rush to end di war.
"Dem be good poker players, but dem dey die," Trump tok. "I no get any
time schedule. I no dey rush."
Di president tok say di upcoming November midterm elections for US "no
get anything to do wit wetin im dey think." E also argue say di US no
get issue wit di weapons wey don dey finish since di war start, e argue
say "wetin we don use na peanuts."
Di exact money wey dem use for ammunition and di remaining stockpill
still no dey public. But data wey dem publicly comply for Washington DC- based Center for Strategic and International Studies (CSIS) show say di stockpiles don dey finish, and for di short-term, e go hard for dem to replace am.
Retired Marine Corps colonel and senior adviser for CSIS tell BBC say e
dey usually take "one to five years" to make one missile.
"And nothing wey you fit do to speed di process."
Di MoU wey dem sign on18 June, na to bring both sides on permanent
ceasefire but di temporary peace fall apart as both sides dey throw
strike at each oda not long afta.
On 8 July, Trump declare say di ceasefire don "ova".
As di ceasefire don dey near make e expire on Monday, Trump still post
for im Truth Social network say: "Di number one goal be say, and e go
always be, dat Iran no fit get nuclear weapon, in any way, shape, or form."
https://www.bbc.com/pidgin/articles/cwy4z73n3dno
BBC too sabi. Dem don butter my bread. Dis na how Twump bin dey suppose always don report.
| Sysop: | Amessyroom |
|---|---|
| Location: | Fayetteville, NC |
| Users: | 74 |
| Nodes: | 6 (0 / 6) |
| Uptime: | 05:05:57 |
| Calls: | 1,194 |
| Files: | 1,353 |
| D/L today: |
2 files (1,590K bytes) |
| Messages: | 291,507 |